Pidgin Vibez

Pidgin Vibez

News EN ↓ 128 episodes

Welcome to Pidgin Vibez Podcast! We dey bring you unfiltered, evriday conversations from all corners of life. Whether na trending gist, real life experience, funny stories, or normal evri day wahala, we dey tok am all. No script, just real tok for pipo wey wan hear di gist as e be. Tune in for fresh yarnings and join our community as we explore different topics, laugh, and reflect. No forget to hit follow, so you neva miss any episode of di vibez!

Author

Pidgin Vibez

Category

News

Podcast website

pidginvibez.ng

Latest episode

May 1, 2026

Where to listen?

Podcasts in the app Replaio Radio Coming soon

Podcasts are coming to the app soon. Install now and be the first to see a whole new take on podcasts

Get it on Google Play Install for free Android 5M+ downloads · 4.8 rating iOS soon

Episodes

EFCC Don Carry Persin Again! Wahala For Naira Spraying 03.05.2025

Gbege don shele again o! EFCC don knack arrest on top say persIn dey spray naira for party like say na tissue. For dis episode, we go run you di full mata, how e take happen, wetin EFCC yarn, and di kind wahala wey dey wait anybod. wey still dey plan do am. You wan flex? Beta shine your eye. EFCC no dey smile again! Abeg LIKE, DROP COMMENT & SUBSCRIBE sharp-sharp for more beta gist wey dey hot...

Mama & Papa, See Why You Must Visit Your Pikin for Skul Witout Notice! 28.02.2025

Mama & Papa, you sure say you sabi wetin your pikin dey do for skul? 🎓🤔 Some students get double life, one for house, anoda one for skul! If you no waka go check dem witoutnotice, you fit open eye see tins wey go shock you! 😨 For dis episode, we go yarn: ✔ Why e important to surprise yourpikin for skul 👀 ✔ Shocking tins wey parents dondiscover 😱 ✔ How e go help your pikin stay focusedand...

UEFA Champions League Round of 16 Draw 23.02.2025

Omo! UEFA Champions League Round of 16 Draw don land, and e choke! 😲 See as big teams dey jam dem selves for knockout stage. Who go qualify? Who go shock evri bodi? We go break down all di matchups, analyze di key battles, and drop our predictions! 📢 No forget to LIKE 👍, COMMENT 💬 your predictions, and SUBSCRIBE 🔔 make you no miss any UEFA Champions League gist!

Wahala for Naija! See Wetin Dey Happen for Present-Day Nigeria 10.02.2025

Naija don cast? From moni wahala to insecurity, bad goment, and job problem, e be like say kontri dey shake. Make sure say you LIKE, COMMENT & SUBSCRIBE make you no miss beta gist

Liverpool Fit Win All 4 Trophies Dis Season? | Dem Go Make History? 07.02.2025

Liverpool fans, una feel say dis season go be d season of dreams? Arne Slot boys dey fight for all fronts, but e still sure say dem fit carry all 4 trophies? For dis yarning, we go break down Liverpool form, key matches wey remain, squad strength, and d wahala wey fit stop dem! Dem go make history or na anoda heartbreak go land? Drop your prediction for comment section! You believe say Liverpool f...

Arsenal Celebration vs Man City – E Too Much or E Make Sense? 06.02.2025

Arsenal celebration afta dem beat Manchester City don cause serious wahala! E too much or dem get right to celebrate like dat? Some people dey vex say e no make sense, while odas say na pure passion afta dem fight hard for di win. Wetin you think? No forget to LIKE, COMMENT, and SUBSCRIBE for more football gist and analysis! Drop your opinion for comment section: Arsenal do too much or e make sens...

Hard Drugs Wahala: Silent Crisis Wey Dey Spoil Lives! 29.01.2025

Hard drugs wahala don pass be careful! For evri wia, drug abuse dey scatter lives, break families, and increase crime. Dis mata no get boundary. But why e dey spread like wildfire? Who dey behind am? Wetin we fit do stop am? For dis eye-opening video, we go break down: Di real wahala wey drug abuse dey cause for society How hard drugs dey affect pipo life True life stories of pipo wey don fight ad...

Nollywood & Cinema Gbese 08.01.2025

Dis episode di yarnings na about di issue wey film makers for Nollywood dey get wit Cinema. So I come discuss weather na di duty of di cinema to dey promote one film pass di oda film? I come see yarn weather e make sense make cinema staff dey try totori your mind to watch one film even though say no be dat film you say you won watch. Dis one and more na full di yarnings for dis episode.

BurnaBoy vs Cubana ChiefPriest 05.01.2025

Dis episode yarnings na about di on-going beef between Burna Boy and Cubana ChiefPriest Who really get di title moni na water? So far Burna Boy don help di guy wey say im na Cubana ChiefPriest broda wit 30k dolls, while di woman wey come out say im get son for am, help see dey come for dat one. Cubana ChiefPriest don reply say im go help Akpi commot jail. Who dey win so far?

Saudi League & French Ligue 1 Which One Beta Pass 03.01.2025

For dis episode my yarnings go dey come from wetin Cristiano Ronaldo tok, wen he say Saudi League beta pass French Ligue 1. I touch about why di yarnings get small truth inside, and why lack of funding see dey affect di league. For una opinion who una reason say beta pass between di Saudi League and di French Ligue 1?

Make Una Leave Burna Boy 02.01.2025

For dis episode my yarnings na about Burna Boy. I tok about why Nigerians dey always over react wen di matter na always about Burna Boy? I yarn about how Nigerians need to do beta and try dey respect all dis artistes, as e be say di guy don tok am say make fans no dey run enta im stage wen im dey perform. I see yarn on di guy decision to end im performance for di Lagos countdown show for 31st nite...

Tiwa Savage Di Queen of Afrobeats 31.12.2024

For dis episode my yarnings go be about di Queen of Afrobeats, Tiwa Savage. Di tori na about her post about say her new album wey go soon drop fit be her last album, as she say she don tire and she self don try. I yarn about how Nigerians need to value her more and give her, her flowers, I see talk about how she dey represent for different gene of music. How she see pave way for female artists for...

Hapi Birthday Sky Jesus 24.12.2024

Dis episode na about sky Jesus birthday. I yarn about how we need to dey observant for di drinks wey we dey take in dis period. I yarn about different safety measures. I see yarn about how as e be say na season of love, make we spread love to pipo wey dey around us as notin too small to take put smile for pipo face.

Ademola Lookman Di Best For Africa 19.12.2024

For dis episode my yarnings na about Super Eagles and Atalanta forward Ademola Lookman. I yarn about di rumour wey be dey waka about say na Real Madrid Brahim Diaz won win am. I yarn about am choosing Nigeria ahead of England. How he always dey available to play and dey always deliver for pitch. How he no allow wetin happen for Fulham define im career.

Movie Review (Roses & Ivy) 17.12.2024

For dis episode I yarn about how BIODUN STEPHEN na di real GOAT for Nollywood. Roses & Ivy na must watch for evri bodi, lessons dey for una to learn. Di movie na solid 9/10, di cast, di costumes, evri tin give wetin e suppose give. Make evri bodi wey involve for di making of dis film take dia flowers, dem too much.

Chelsea Na Premier League Favourite 09.12.2024

For dis episode I go dey yarn about Chelsea so far dis season. I yarn about how Chelsea na league favourite even though say dia manager dey deny am. I tok about di unity for di team now. I yarn about how Arsenal no serious to win di league and how dia manager no get di courage to take make big decisions. I come yarn about how Liverpool, Manchester City and Chelsea be di Favourites for di title.

Corner Kick No Be Part Of Football? 05.12.2024

For dis episode I go dey discuss about di Premier League match between Arsenal and Manchester United yesterday for Emirate Stadium. Di Arsenal corner kick and if corner kick na part of football? Why Manchester United fans and dem Legends dey rant about corner kick?

Post Edo Election 03.12.2024

For dis episode I go dey yarn about wetin dey happen so far afta di Edo election. Di probe of di old administration. Di crowd wey dey follow di new govnor. And di many tok tok wey dey happen between di old and new administration.

Manchester City Wahala 27.11.2024

For dis episode I go dey discuss about di wahala wey Manchester City dey and how Rodri injury dey affect dem di way e take affect Arsenal wit Saliba dat year.

Economy Wahala 06.11.2024

Di situation of di economy no funny again. How business pipo dey take cope for di present day economy? Na wetin go beta anytime soon?

CNG Conversion 04.11.2024

Dis CNG update e don come to stay abi na for di now? Dis CNG conversion na wetin dey safe? If accident happen e no go explode?

Edo State Govnorship Election 19.09.2024

For dis episode I go dey yarn about di Edo State Govnorship Election wey dey happen for 21st September 2024. I yarn about: why e dey important for citizens to dey protected. Wetin make if election dey come for we kontri evri wia go dey hot? Why e no be compulsory matter to dey tell citizens make dem no sell dia votes cos evri bodi dey feel wetin dey sup for di Nigeria of today.

International Break Injury Palava 12.09.2024

For dis episode I go dey yarn about di international break. Weather di matches too much for di players? Di different tournament wey kontries dey play e dey important? I believe say time don reach wey we go take hear di complain of di players.

Fuel Price Wahala 06.09.2024

For dis episode I go yarn about di new fuel price, how e go take affect cost of tins and how e go affect pipo wey dey do business. How e be say fuel take dey part of evri tin and na part of di reason wey make cost of living high.

John Obi Mikel vs Nicolas Jackson 28.08.2024

Dis episode na about di John Obi Mikel and Nicolas Jackson fight wey dey happen for town dis pass days. Who dey wrong and who right for dis matter? John Obi Mikel na Chelsea legend?

Listen to the Pidgin Vibez podcast in Replaio

Radio and podcasts in one app - free, with no sign-up. Install today and do not miss the launch

Get it on Google Play

Replaio is not a podcast publisher; show names, artwork and audio belong to their authors and are distributed through public RSS feeds.