Pidgin Vibez
Pidgin Vibez
Welcome to Pidgin Vibez Podcast! We dey bring you unfiltered, evriday conversations from all corners of life. Whether na trending gist, real life experience, funny stories, or normal evri day wahala, we dey tok am all. No script, just real tok for pipo wey wan hear di gist as e be. Tune in for fresh yarnings and join our community as we explore different topics, laugh, and reflect. No forget to hit follow, so you neva miss any episode of di vibez!
Where to listen?
Podcasts in the app Replaio Radio Coming soonPodcasts are coming to the app soon. Install now and be the first to see a whole new take on podcasts
Episodes
NIGERIA DEY BLEED 💔 Wetin Really Dey Happen for Dis Kontri? 20.11.2025 6:04
Islamic terrorists don launch anoda deadly attack for Nigeria, and di kontri don enter anoda round of fear, tension, and mourning. From villages to towns and even cities, these attacks dey affect innocent Nigerians wey just dey hustle to survive. Dis na the kind gist wey evri Nigerian suppose hear. Listen till di end, drop your thoughts, and subscribe for more real Naija updates.
RESIDENT DOCTORS DON VEX | NIGERIA GOVT NO SEND DEM AGAIN? STRIKE WAN SCATTER HEALTH SECTOR 19.11.2025 3:43
Resident doctors for Nigeria don enta anoda serious strike and di mata dey hot Dem dey complain say goment no dey show concern at all, salary wahala, poor hospital equipment, work overload and no beta welfare. Make you listen to dis sotey you go understand di full gist clear. No forget to LIKE, COMMENT your opinion, and SUBSCRIBE make you no miss any tori.
WIKE & PDP Governors Scatter Abuja | Police Even Dey Fight Themselves for Politicians 18.11.2025 3:54
Omo today hot for PDP Secretariat for Abuja. Wike and some PDP governors nack gbege, tension come burst evri wia as Nigeria police begin fight demselves because of politicians mata. Abeg make you LIKE, COMMENT and SUBSCRIBE make you no miss any political gist for Naija. Na here you go always get correct update as e dey hot.
SUPER EAGLES 1–1 CONGO | DRAMA AS NIGERIA FALL FOR PENALTIES 16.11.2025 3:22
Super Eagles fans no smile today as Nigeria play 1–1 wit Congo for World Cup 2026 Qualifiers, but come waka commot afta penalty shootout wahala. Abeg LIKE, COMMENT & SUBSCRIBE if you dey enjoy Pidgin football gist. Make we run dis channel go worldwide.
PDP 2025 Convention Wahala! Wike, Fayose & Anyanwu Don Finally Chop Expulsion 16.11.2025 4:22
Omo, PDP 2025 National Convention no be small drama at all. Big big men like Nyesom Wike, Ayodele Fayose and Samuel Anyanwu don finally jam expulsion for inside party. Abeg LIKE, COMMENT and SUBSCRIBE make you no miss any political gist wey dey drop hot.
SUPER EAGLES 4–1 GABON | World Cup 2026 Qualifier Wahala 13.11.2025 3:33
Super Eagles no even gree breathe as dem burst Gabon 4–1 for dis World Cup 2026 Qualifier showdown. Na pure football madness as Naija boys show class, ginger, and correct finishing. If you dey love Naija football, dis match na one you no suppose miss at all. Abeg LIKE, DROP your thoughts for comment section, and SUBSCRIBE make you no miss any Super Eagles update, highlights and all World Cup 2026...
Benin Mini Bus Don Turn Trap? Kidnap Gist Wey Go Shock You 11.11.2025 4:42
My pipo, wahala don burst o! Mini bus wey we dey use waka for Benin City don turn sometin else. Dem say some bad guys don dey use am for kidnap, robbery, and oda evil waka. For dis yarnings, we go yarn una: How dem dey run di kidnapping inside mini bus for Benin. Wetin you go check before you enta any bus. Small-small safety tips wey fit save your life. Make you no just listen alone, like, share,...
BENIN–SAPELE ROAD DON CAST 😭 | See As Pipo Dey Suffer for Dis Bad Road 07.11.2025 5:50
Omo! Dis Benin–Sapele road don turn sometin else oo. Pipo dey suffer, motors dey break down, trailers dey fall, and no single help from goment. Evri day drivers dey beg make dem fix am but notin still happen. Persin fit spend hours for just few kilometers because of pothole wey big pass swimming pool. Abeg listen till di end, drop your comment, like, and subscribe make we dey expose all dis kind w...
Work Don Hot! Flyover Bridge Dey Rise for Ramat Park for Benin City 04.11.2025 3:12
My pipo, work don really choke for Ramat Park Flyover Bridge inside Benin City o. Dis bridge project na one of di biggest wey dey happen for Edo State right now, evri wia don full wit caterpillar, concrete and heavy machine wey dey reshape di whole area. No forget to like, share & subscribe for more Benin City updates, Naija construction gist, and Edo State development.
Arsenal Don Climb Top Again🔥 27.10.2025 5:21
Arsenal don show say dem no dey play dis season. Gunners don waka go top of di Premier League table afta anoda mad performance wey scatter evri wia. Arteta boys dey on fire, but you think say dem fit hold dis top till end of season? No forget to like, drop comment, and subscribe make you no miss any Arsenal gist again.
OBA Market Renovation for Benin City - See as di Place Don Turn! 26.10.2025 2:42
My pipo, dis na di real update on OBA Market renovation for Benin City. We waka reach di market ground to see how far work don go, how e dey affect traders, plus wetin dey sup for di area now. You go shock wen you see di current state. If you dey from Benin City or you sabi Edo vibez, you go feel dis one wella. No forget to like, drop your comment, and subscribe make you no miss any Benin or Edo S...
CAF Reject Naija Refs Again 😳 24.10.2025 3:36
CAF don shock Nigerians again as dem reject Naija referees for anoda major African football tournament!. Why CAF no dey trust Nigerian refs? Na bias, politics, or poor performance? Make sure you like, drop your take for comment, and subscribe so you no miss any fresh football gist wey go drop next.
Naija Safe Like Dis? 13.09.2025 4:03
Naija na one of di most lively kontri for Africa, but di big wahala be, Naija really safe like dis for 2025? Di way our young pipo dey find moni dis days dem dey do evri tin and anytin for di moni to come. Di yarnings na about wetin no good wey come be normal for our surroundings. Abeg no forget to like, drop comment, and subscribe.
Arsenal Shock Man United 1-0 for Old Trafford | Premier League 2025/26 Opener ⚽ 17.08.2025 3:25
Na wahala opener be dis one o! Arsenal don knack Manchester United 1-0 for Old Trafford as Premier League 2025/26 season start. Di match choke, Gunners show strong defence, sharp ball play and dem still run United down for dia own home. Arteta boys carry 3 points waka comot Old Trafford, Red Devils fans shock scatter. No forget to like 👍, drop your comment 💬 and subscribe 🔔 for more Premier Lea...
Why Married Women Dey Cheat Anyhow for Naija | Wetin Really Dey Happen? 19.07.2025 4:23
Wetin dey make plenty married women for Naija dey cheat on top dis husband? We unpack all di real gist wey dey cause infidelity for Nigerian marriage today. Na time to ask, Na who fault am? Men or women? Or na society wey don spoil? No dull, like, drop your comment, and subscribe to catch more hot gist about Naija lifestyle, relationship gbege, and society mata.
Gym Don Turn Runway? Babes Dey Show Skin Like Say Na Fashion Show 18.07.2025 4:08
Na wah oh! Dis gym no be normal again babes dey pull up wit outfits wey go make you shout “Jesu! From crazy crop tops to tight leggings wey leave notin to imagination, di gym don turn mini runway. Wetin really dey happen? Na confidence or clout chasing? Listen, drop your hot take for comment, and make sure you LIKE, SUBSCRIBE, and ON BELL 🔔 for more crazy gym trends, fashion wahala, and lifestyle...
Naija Rain Wahala No Be Here | You Gats Know Wetin Happen 15.07.2025 4:11
Omo! Once rain start for Naija like dis, na gbas gbos full evri wia. We go yarn wetin we dey face anytime rainy season land and wetin we go gat do to see play safe. Whether you dey Benin, Lagos, PH, or anywia for Naija, you go relate sharp-sharp. Na real-life Naija rainy season wahala we package for here o. Make you listen till di end, laugh small, and if e touch you LIKE, COMMENT & SUBSCRIBE...
Dis FIFA Club World Cup Mata - E Really Worth Am? 10.07.2025 3:58
Abeg make we tok true, dis FIFA Club World Cup wey FIFA dey always hype, e really make sense? Abi na just anoda jamboree wey no get beta impact? Na European clubs dey win am evri time, fans no dey too show, and di whole tin dey feel like say na moni runs. Di players dey play too much games, but clubs need di moni. Na real football tok we dey do here. 💬 Drop your take for comment. 🔔 No forget to...
DENGUE FEVER DON LAND FOR EDO STATE 08.07.2025 3:53
Dengue Fever don show face for Edo State and e no dey smile at all. Pipo dey sick, hospital don full, and fear dey evri wia. For dis video, we go run am as signs wey you go see, and how you fit take protect yourself and your pipo. Na mosquito dey carry di Dengue Fever, no dull o! If you dey Benin or anywia for Edo, dis gist na for you. 📢 Make you watch am sharp-sharp and share give your people. E...
ADC Coalition: Na Setup Abi Na Blessing? 07.07.2025 4:04
Wetin be dis ADC Coalition wey evri bodi dey tok about? Na beta plan for di future of Nigeria politics or just anoda political waka-pass? Join di conversation drop your thoughts for comment section Make sure you like, subscribe & tap dat bell so you no go miss any gist.
Wetin Dey Worry Arteta? E Don Go Collect Anoda Chelsea Player 06.07.2025 3:54
My pipo, Arteta no wan rest oh! Afta all di Chelsea players wey e don eye, e don dey drag Noni Madueke now join Arsenal wahala. Na wetin dey really sup? Dis video go break down why Arsenal dey rush Chelsea boys like say na Black Friday sale. Drop your mind for comment section. You reason say Madueke go deliver for Arsenal or Arteta just dey craze for Chelsea players? Abeg no dull, Like, Comment, a...
2Baba Apology: Wetin Really Dey Happen? 04.07.2025 4:38
Omo! Afta dat podcast wey 2Baba do wit Nedu, baba drop one apology video wey dey confuse evri bodi. Wetin make am dey apologize? Who dey record am? Pipo don begin tok say baba attitude and im doings no clear, and social media don scatter wit reaction. No dull, drop your opinion for comment, like di video, and make you subscribe for more Naija celeb gist!
E Don Happen! Kepa Don Sign for Arsenal | Arteta No Send Anybodi 03.07.2025 3:06
Omo, e don set! Kepa Arrizabalaga don waka enta Arsenal camp gbagam Mikel Arteta no dey play at all dis one na serious gbos gbos for Premier League o. No dull! Abeg LIKE, DROP COMMENT, SUBSCRIBE and tell us if dis move make sense or e be wahala. Make we reason am togeda Who go chop bench now? Kepa or Raya? Drop your take below 👇🏾
Wizkid Don Cancel Tour?! Wetin Really Happen Go Shock You 11.05.2025 4:14
Omo e don happen! Wizkid don shock evribodi as e cancel im tour just like dat . Na health wahala? Low ticket sales? Or dem dey hide sometin for back? Make una no reason am alone , for dis episode, we go run full gist wey dey street and wetin fans dey yarn. Starboy no show face again , see wetin go really make am cancel dis tour. Na full breakdown be dis! Abeg no dull! Like, drop comment, subscribe...
Public Bus Safe Like Dat? Wetin Dey Happen Inside Go Shock You 04.05.2025 5:06
You dey enta public bus steady? You go wan listen first! We run street check on wetin dey really happen for inside public bus, from small gbege to serious wahala wey fit happen anytime. We tok true tok about how to shine eye, stay safe and no carry last inside any public bus. . Whether na daily hustle or one-time waka, dis yarning go open your eye. 🔔 Abeg like, drop your take for comment, and sub...
Similar podcasts
Replaio is not a podcast publisher; show names, artwork and audio belong to their authors and are distributed through public RSS feeds.