Pidgin Parlour
Pidgin Parlour Crypto Podcast
Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey everyday African go fit dey relate with. And all these things go dey for pidgin, the localized language wey over 75 million Africans dey speak. This pidgin parlour crypto podcast dey bring crypto education and culture come inside street."Pidgin Parlour is the centre of crypto education and culture for the everyday pidgin-speaking African. The show breaks down complex crypto concepts into bite-size...
Be sure to visit the podcast's website and support the creator: rss.com
Where to listen?
Podcasts in the app Replaio Radio Coming soonPodcasts are coming to the app soon. Install now and be the first to see a whole new take on podcasts
Episodes
Wetin be Bitcoin ETF? 26.02.2024 18:13
Real world Assets Who go believe say dem go ever approve ETF for di crypto space, dis mata go loud!. As you don hear say dem don approve BITCOIN ETF, e just be like say dem dey cap cause ETF na mata wey dey popular with Stock, bond, and other investment fund and no be Crypto. However, as dem don approve dis model, everibodi dey happy because e mean say plenti Pipo go like shook mouth f...
Pidgin parlour New year Jamz 24.01.2024 34:52
Happy new year all of na wey dey follow us for Africa and we dey happy say all of una don enter 2024 and you dey kampe. As our culture be for pidgin parlor we go like give una update for everything wey we do for 2023 and wetin you suppose expect for di new year. So make una sit down as we gada reason wetin dey happen for pidgin parlour. Oya download, make una listen and give your Pipo too. Enjoy t...
How NFT go be for bull run? 28.11.2023 29:14
How pesin go pay $1million for pictures, wey una fit just carry anywhere? Na wetin layman dey ask be dat when dem hear about NFT, so today we wan check wetin be NFT and how una fit profit from dis mata in crypto. We don go carry Arrow come studio today as Im dey give us NFT alpha for dis episode For dis episode, una go understand. Wetin be NFT How dis images dey operate How una fit profit from NFT...
ReFi dey change di World, Una don hear? 27.11.2023 50:36
ReFi, wey oyinbo Pipo dey call Regenerative Finance, dey change di world. Dis one no be lie o, na correct matter. Many Pipo wey dey web3 dey do DeFi, Desci, NFT, Degen, but only small % dey reason ReFi… Di reason be say ReFi no dey run as others dey behave, but as una go dey hear for dis episode ReFi dey change Pipo life and many Pipo no even sabi… Na why I call one maxi wey dey di ReFi space make...
Asset wey dey real life (Real World Asset), wetin dem be? 16.11.2023 34:04
If you no know, Pipo wey dey outside web3 don dey shook dia moni inside di market now… As everywhere don dey green small small, one question wey una dey ask be say where all dis moni dey come from… Na where Assets wey dey for correct world(Real World Asset) show face be that. Dem dey give Pipo wey dey outside web3 chance to shook dia money inside di market. Una dey feel di gist Che? So for dis epi...
Make we reason Social-fi (2) 01.11.2023 29:44
Una don hear about De-Fi, Re-Fi and De-sci, but today we wan talk about Social-Fi. If you dey CryptoX, you go realize say this narrative dey common as everyone dey talk about it and many founders too dey create product along this line. Na why I follow Scar reason this mata be dis, as we talk about. Wetin we social-Fi and how e dey work? Wetin be solid examples of social-fi and how we fit position...
Dem talk say ''show-up daily'' how una dey run dis tin for web3? 11.10.2023 42:03
Wetin una dey do every day na im dey make Pipo achieve success, oyinbo Pipo dey call am "Consistency". Even for dis web3, if una go make am, u no fit do without am. For dis episode our ogbonge host and Vykthur_X gada discuss di mata of consistency. You go learn : Wetin consistency be and how u fit run am. 2 things you must know about web3 if you go dey consistent. How you fit show up daily even if...
Wetin be Social-Fi 07.10.2023 26:17
Una don hear about De-Fi, Re-Fi and De-sci, but today we wan talk about Social-Fi. If you dey CryptoX, you go realize say this narrative dey common as everyone dey talk about it and many founders too dey create product along this line. Na why I follow Jay-1 reason this mata be dis, as we talk about. Wetin we social-Fi and how e dey work? Wetin be solid examples of social-fi and how we fit position...
Worldcoin : Kasala wey dey for inside! 26.09.2023 30:56
Hope dem neva collect your iris take give you token?? Haha, Oya relax make we gather reason dis mata, una don hear the buzz of dis world coin mata as e fill di internet. Every one dey reason say wetin di founder of dis project dey try do, some Pipo dey bullish about di project, while others just dey vex for di idea. Na why I follow my guy "Scar" discuss for dis episode be that on top dis World Coi...
Web3 Funding : Wetin You for Know! 26.09.2023 36:39
Money mata for web3 na serious talk, cause e dey possible make a person wey be founder get beta project idea wey go bring beta solution for dis space, but if e no get money. Dat idea don die before dem begin. So for dis episode, we gather talk how founders fit get access to beta funding for dis web3 space. You go learn : Types of funding wey dey di web3 space. How you fit access dis funding. Which...
Make We Reason Desci with LifeofDan-EL 25.08.2023 35:37
As we don talk am before say blockchain get plenty things wey we fit use am for. Many Pipo don hear about DeFi, NFT, and others, but una don hear about "DESCI". Wetin dey sup? For dis episode our guest na di founder of Desci Africa, dem dey try build Desci for Africa - dis one go make research wey dey happen for science decentralized. Omo, dis one shook me for body… For dis episode you go learn: W...
Tokenomics : Optimism dey do am Right? 03.08.2023 36:10
Una don see hear wetin we talk for the 1st part of this topic, how tokenomics dey important for di success of any project. Today we go dey reason Optimism ecosystem and see wetin dey happen for their tokenomics and wetin one or two projects fit learn about thier ecosystem tokenomics You go learn: Some terms for tokenomics wey go let you understand the subject better. How Optimism Tokenomics dey wo...
Make We Reason Branding for web3 w/ Goodnews 27.07.2023 50:45
If any project /pesin go win for this web3 dem suppose understand wetin be branding and how dem suppose make people like dem. All dis thing na im dey call branding, and na di difference between pesin wey go charge $5k or someone wey go charge $5.For dis episode, Our guest wey be branding expert, tell us how pesin fit begin and grow their brand for dis web3 space. You go learn: Wetin be branding an...
Make we reason Tokenomics : 101 07.07.2023 50:32
If you wan understand if any crypto project na ogbonge, you must to understand the tokenomics. This matter no dey complex at all, yet im be like say many pipo no under am. If una remember how dem teach us economics for primary school, na dat same model tokenomics follow dey work. As an investor, if you know Sabi wetin tokenomics be, you fit go put your money for wetin go burn your finger, na why f...
SEC & Binance Matter : Wetin U for know w/ Bio Francis 25.06.2023 48:31
E don tey wey Pipo don dey talk about regulations for the crypto space. Some Pipo talk say the thing dey too risky and e suppose dey regulated, others believe say if dem regulate am e no go make sense again. But wetin we see for dis past few days NAWA!! Im be like say village Pipo remember "CZ" wey be binance CEO, the regulatory body just dey drag am say Im dey do anyhow for the crypto space, this...
Make we reason BRC20 tokens! 14.06.2023 45:32
Everyday we dey see new things for the crypto space, but dis one wey we wan talk na new thing entirely because many Pipo wey dey crypto Twitter don talk say Im no fit happen. You dey wonder say wetin happen? Na bitcoin blockchain launch token o, and everybody dey surprised because Pipo don talk say Bitcoin na just store of value, others even talk say na shitcoin. But as dem launch dis "BRC20 TOKEN...
Blockchain & Beyond Conference 08.06.2023 43:59
Research don talk say Africa dey middle of blockchain revolution wey dey happen for the world as blockchain education dey happen for everywhere across Africa. Pipo, they put dia money for ground make plenti Pipo learn about this new technology and on top today's episode we get "Ezenmo Blockchain" wey be the co-founder of Blockchain UNN come share with us about how this blockchain fit touch every a...
Episode title : Founder tori with Lydia Mark, founder of Web3 Woman Hub, 30.05.2023 42:32
Many pipo don assume say when we dey talk tech mata, Web3 or blockchain talk make women no put mouth because Im be like na only men dey rule the space. Especially for Africa, di mata na serious one as Im be like say na only for kitchen women suppose dey shine. Na dis matter our guest for today's episode see wey make am say although life no balance originally but for this mata "Things suppose balan...
Make We reason Optimism - Chain Metrics & Future 23.05.2023 41:20
If una don dey follow our podcast on top the optimism ecosystem I know say today gist go sweet una for body as many pipo don ask us say how we fit know if this Optimism wey you dey talk na beta project wey I fit shook my mouth. Na dis question we wan ansa dis week for pidgin palour as Crossvic and Bintuparis take break down the metrics on top Optimism blockchain. For dis episode, you go learn: The...
Make We Reason Optimism 17.05.2023 40:05
Optimism na one of the major layer 2 solutions wey dem build to solve the problem of Ethereum scalability. Dis ecosystem good so tey im dey attract several builders wey dey build their project on top am. If you no understand how Optimism take enter market, today's episode go teach you everything wey you suppose know about the optimism ecosystem. You go learn things like: Wetin Optimism be and how...
Sui Network : Wetin Dey Sup? 30.04.2023 45:00
Sui network don cause kasala for Twitter last week as many pipo dey rant say dem no dey do airdrop. Before we talk airdrop mata, di first be be say: Wetin be Sui network? Wetin be di difference between Sui blockchain and other blockchains Who be di founder of this project and how di network dey take work. Che na true say dem no dey do Airdrop, if them no do, how you fit position yourself for the b...
Web3 Marketing - How you fit sell your project for web3 25.04.2023 57:16
If you no sabi how you fit sell your project to pipo for dis web3 space, poverty go chop your eye. No cap! But the challenge for many pipo be say dem dey use the marketing strategy wey dem sabi for web2 inside web3 and im dey flop most of the times. Na why we bring Olabisi come this show today (web3 growth marketer) make im explain to us how im dey do marketing for web3 and how any project fit do...
Wetin be Optimistic & ZK rollups? 18.04.2023 52:33
Several innovation don come out since the beginning of dis layer 2 scaling solutions. Na there you go find innovations like - Sidechains, Rollups, plasma and channels and all of dem dey come to solve the wahala of scalability on top the blockchain. As all dis innovation dey so, people come dey further ask say which one better pass for all the Layer 2 scaling solutions, na the thing wey I and my co...
Wetin be Layer 2 solutions and why we need am with Salvi? 14.04.2023 30:44
As Una don know say if any blockchain ecosystem go dey perfect, im suppose get 3 things wey be :decentralization, security and scalability. However, no blockchain don get dis features complete. The best of them wey be "Ethereum" get 2 out the 3 features: Decentralization and Security but I'm no dey scalable. Na why transactions dey slow on top ethereum and if im go fast, you go pay plenty gas feeM...
Founda tori wey go jinja you for web3 with Denise of Astut Community Management Agency 28.03.2023 47:05
Di secrets of pipo wey don make am dey inside dia tori, if you wan do wetin dem dey do, the best thing to do na to listen to their tori. On dis Pidgin Palour Crypto podcast episode we bin get deep conversation with di founder of Astut Community management agency (Denise). Im na young founder wey dey do big things for the web3 space. Im achievement at a very young age na thing wey dey cause many pu...
Similar podcasts
Replaio is not a podcast publisher; show names, artwork and audio belong to their authors and are distributed through public RSS feeds.