Pidgin Parlour

Pidgin Parlour Crypto Podcast

Education EN ↓ 65 episodes

Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey everyday African go fit dey relate with. And all these things go dey for pidgin, the localized language wey over 75 million Africans dey speak. This pidgin parlour crypto podcast dey bring crypto education and culture come inside street."Pidgin Parlour is the centre of crypto education and culture for the everyday pidgin-speaking African. The show breaks down complex crypto concepts into bite-size...

Be sure to visit the podcast's website and support the creator: rss.com

Author

Pidgin Parlour

Category

Education

Podcast website

rss.com

Latest episode

Feb 28, 2025

Where to listen?

Podcasts in the app Replaio Radio Coming soon

Podcasts are coming to the app soon. Install now and be the first to see a whole new take on podcasts

Get it on Google Play Install for free Android almost 10M downloads · 4.8 rating iOS soon

Episodes

Wetin una suppose sabi ontop Bybit $1.4billion hack. 28.02.2025

Many yawa gas for di month of February for dis crypto space and one of dem wey touch everybody na say dem hack the 3rd largest cex of $1.4billion. Chaiii, dat one reach everybody. If dis matter reach una side make una download and listen. ode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/P...

Make we reason how inflation fit affect una crypto 01.02.2025

Inflation for economics na when prices of tinz dey go up and una no moni no fit catch up. Pesin talk say inflation no dey affect crypto, odas talk say even crypto dey hear am. Wetin una wan believe!! Na why we gada discuss inflation mata for dis episode be dat. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your...

Wetin una suppose know about Bitcoin dominance for dis 2025 31.01.2025

Many pipo dey worried about Wetin dey sup for BTC for dis bull run, e be like say dem don reduce e influence for di market. Cause normally as BTC rise, other crypto suppose rise join, but e be like say BTC no even dey affect the market again. Na why we gada today come reason Wetin dem dey call BITCOIN DOMINANCE. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey...

Che na true say na memecoin get dis season, Abi na wash?? 30.01.2025

Memecoin don dey do plenty numbers for dis particular season, and e be like say many people dey reason say e like say na dem get dis cycle. For token 2049 conference, Murad talk beta tinz about dis mata and na on top am we dey gada discuss. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. T...

7 tinz una no suppose do for di crypto space dis 2025 27.01.2025

Dis 2025, na year wey una no suppose make any mistake for dis space. we don gather discuss 7 kind of mistake wey pipo wey dey inside dis web3 dey make. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Subscribe to our newslett...

Dis tokens wey don kpai,go soon rise for inside dis bull run! 28.12.2024

How una take Dey see project like , hedera, XLM and XRP. Many pipo talk say, no show for dem for inside dis run again, but no be Wetin dia chart talk be dat. For dis episode, we gada reason Wetin dia chart talk. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter :...

5 crypto stocks una suppose look into for dis run. 25.12.2024

We still Dey inside dis run and mani pipo Dey reason how dem fit make plenty money inside dis run. Crypto stocks na one major option wey una fit look and e don Dey simple now cause una fit run am inside una bank mobile app. Na Wetin Revayahh gather discuss for dis episode be dis. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice...

Dem talk say “Supra” fit waka pass “Solana”, how una take see am? 22.12.2024

Supra dey try solve di wahala wey blockchain get wey dem Dey call Blockchain trilemma, dem talk say dis innovation for make Supra pass Solana. Na Wetin we gada reason for dis episode be that. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer -Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginP...

Beta ways wey una money fit work for you inside dis bull-run 29.11.2024

As market det fly for dis bull run wey we dey so, mani pipo dey ask say how dem for make dia token take work for dem apart from say dem hodl, For dis episode our host “Revayahh” reason di matter so tey e drop alpha wey anybodi for use navigate di market. If dis mata concern una, make una download and listen. Note say: Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well wel...

Maker DAO don rebrand, how dis one fit pay us? 26.11.2024

Maker DAO na one of di top market maker for crypto and dem dey rebrand go sky, dis development go get plenti consequences for di work wey una sabi dem before for di crypto space. For dis episode, we gada reason how una for fit position beta for dis dia development. If dis mata concern una, make una download and listen. Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do y...

5 reasons why I believe say bitcoin go reach $200k for 2025 23.11.2024

Trump don become president, market dey boom and FOMO dey everywhere! Many pipo dey reason say dem no too sabi how dem go make am for dis run. Na why we gada cook beta alpha for dis episode, if you Dey reason how you fit make money for dis run? If dis mata concern una, make una download and listen. ode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research wel...

How you fit retire rich for dis market cycle? 21.11.2024

Trump don become president, market dey boom and FOMO dey everywhere! Many pipo dey reason say dem no too sabi how dem go make am for dis run. Na why we gada cook beta alpha for dis episode, if you Dey reason how you fit make money for dis run? If dis mata concern una, make una download and listen. ode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research wel...

BASE go blow up if bull-run return, make una shook eye for dis 5 projects 30.10.2024

Base blockchain na correct blockchain wey go run up if bull run finally return. As per se na coin base be di mama of di project. If dis matter na true , which project go come do well for dis run? We don sought beta, projects on dis episode wey go do well for dis run. If dis mata concern una, make download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial ad...

TRON dey run for this bull run, how una take see am? 30.10.2024

If una dey follow Wetin dey sup for di crypto space, una go know say Tron ecosystem don dey blow up small small and many pipo dey reason say wetin cause am. Na on top dis matter we gada reason for dis episode. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you F...

Wetin dey sup ontop Aptos ecosystem, why e dey blow up? 26.10.2024

If una dey follow Wetin dey sup for di crypto space, una go know say Aptos ecosystem don dey blow up small small and many pipo dey reason say wetin cause am. Na on top dis matter we gada reason for dis episode. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you...

How superteam dey make Solana ecosystem beta?. Make we yarn! 30.09.2024

Superteam na like super hero wey act marvel movies, plenty pipo wey get talent come together make dem make solana ecosystem beta. Dis innovation don make plenty pipo enter into Wetin Dey sup on top Solana. For dis episode we don bring one member wey Dey superteam make we gada reason Wetin Dey sup for dia inside and how newbie fit enter! If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy...

Make we reason di top 5 BTC Mining firm for di world 30.09.2024

As una don follow our last conversation on top BTC Mining, today we wan reason di top 5 mining firm for di world and how dem Dey take function. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Subscribe to...

Wetin go happen after dem don mine 21 million BTC finish? 26.09.2024

As we don know say BTC get limited tokens and soon now miners go soon finish mining and dem no go dey get reward again. Di question come be, if dem mine finish, how dem come go dey reward pipo wey Dey work on top di Bitcoin Network. Na dis matter, we gada reason for dis episode. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share...

Wetin Dey Sup On top Sei V2 23.09.2024

Sei V1 na beta innovation on top di Sei Blockchain. But in get some wahala wey developers Dey face if dem wan use am, na why dem introduce Sei V2 be dat. For dis episode, we gada reason Wetin Sei V2 bring coke di sei Network. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well w...

5 tinz wey you suppose know if una wan become beta crypto trader 18.09.2024

If una wan become beta crypto crypto trader, some tins dey wey una suppose know wey go make una increase your game for dis crypto market. For dis episode, we gada reason dis mata. If una dey interested in dis mata make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : h...

Gada for here, make we reason African Bitcoiners! 16.09.2024

E be like say , if we talk about cryptocurrency pipe wey be Bitcoiners Dey always reason say, na only them be di correct crypto pipo, say all of una dey play. For dis episode , we invite person wey be OG for di African bitcoin space make em tell us why dem Dey reason like that. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share...

Why dem put parvel durov inside prison? (Wetin una suppose sabi) 03.09.2024

Why dem carry parvel durov enter prison na Wetin everi body Dey shout be dat. some pipo talk say na because government dey beef am for privacy policy , odas talk say na bad pesin inside dis episode, we gada reason why dis mata dey sup. If dis mata concern una, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your resea...

Wetin dey sup on top TON blockchain. 10.08.2024

If una check wetin dey sup for di crypto space una go realize say many projects, Dapps, & blockchain just dey surface for dis bullrun. Out of many tinz wey don sup, TON blockchain dey show beta swag for dis season, as e dey rise, many Pipo dey come build on top di blockchain. For dis episode we gada explore wetin be ton blockchain and why im dey get beta attention for dis season. If dis mata c...

Wetin go sup for Crypto if Kamala Harris enter Office? 31.07.2024

As una don know say U. S election dey always matter inside di crypto market and Donald Trump na di only person wey don show say e dey gidigba for di crypto market. But as una don dey watch Joe Biden don step down take power give Kamala Harris, di question go come bi, wetin Kamala go do, Im go follow trump path or Biden way. We no go know until we know wetin sup for inside dis episode. If dis mata...

How you fit DYOR for dis bull run 13.05.2024

As bull run don show, mani pipo go like shook head for inside the crypto market becos plenty opportunity don come, however as una dey plan to make moni, na so scammer dey also plan to scam mani Pipo. Na why e better make una sabi di tinz wey you suppose know for di market and una fit DYOR so una no go shook your leg inside scammer trap. For dis episode we gada talk: 1.)Wetin be bull run 2.)Di firs...

Listen to the Pidgin Parlour Crypto Podcast podcast in Replaio

Radio and podcasts in one app - free, with no sign-up. Install today and do not miss the launch

Get it on Google Play

Replaio is not a podcast publisher; show names, artwork and audio belong to their authors and are distributed through public RSS feeds.