Darkydey

DARKYDEY IN PIDGIN

Church Of Wisdom And Enlightenment, Knowledge And CreativityThe thing be say na for Pidgin English Podcast na im we go dey yarn about dem things wey concern us the most, we no get time to come dey play with you or your minds, wetin no concern us no go concern us but wetin concern us na im we go talk about. Darkydey na original Naija Man so Abeg wetin? Make una no feel say we dey miss yarn, no! we just wan yarn about wetin we feel say dey important to us bicos everybody dey do like say "E no concern dem" so again, Abeg Wetin? Naija Pidgin English Blogger.

Autor

Darkydey

Kategorie

Education

Podcast-Website

darkydey.com

Neueste Folge

19. Apr 2026

Wo hören?

Podcasts in der App Replaio Radio Bald verfügbar

Podcasts kommen bald in die App. Installiere sie jetzt und erlebe als Erster einen ganz neuen Blick auf Podcasts

Bei Google Play herunterladen Kostenlos installieren Android 5 Mio.+ Downloads · Bewertung 4,8 iOS bald

Folgen

Had A CLOSE ENCOUNTER WITH THE POLICE 10.06.2023

This one I no go wan write or comment on am, I go like make una just listen to wetin happened because e get things wey people dey go through wey some other people go dey think say, na so e suppose be, whereas no bi so e suppose be at all at all. You fit translate our article into any other language wey u wan if you no fit decode Naija pidgin English .

SNAKES ON THE PLANE / A U KNOW SITUATION 03.06.2023

As recorded before the 23 Feb 2023 Naija election. Am serious, God should not have created some people wey dey this our planet, some people are just plain out wicked so tay, dem no sabi how to show or hide their wickedness again. What did we ever do to dis people wey make dem hate us so much? why are they so scare of us? You fit translate our article into any other language wey u wan if you no fit...

LIFE LESSONS/ HOW DO YOU KNOW YOU ARE HEALTHY? 27.05.2023

E get somethings wey be say, if man pikin wan begin talk about am, e go take days to even begin to comprehend it.. make we talk about it abeg. I am Darkydey , and I am vibrating You fit translate our article into any other language wey u wan if you no fit decode Naija pidgin English .

HOW TO FIGHT EVIL ? FIGHT IT WITH EVIL. 21.05.2023

Did you know that the only way to fight and defeat evil is by being evil? Okay, I know this one's gonna come out as blasphemy but truth be told, if you move away from the matrix and indoctrination and see the world for what it actually is, you will understand inner-stand and overstand what am saying in this podcast... Am Darkydey and I am vibrating You fit translate our article into any other...

Buhari, Monkey No Fine But him Mama Like Am 25.02.2023

Ma Naija people, as our oga president tenure don dey draw to an end, abeg i no say no bi everybody infact no body for Naija go agree say, this government bin better in anyway but dat no go stop us fom wishing our out going President Buhari well and good life and health, I know say him as a person bin try him best to see Naija through but if u no know, u no go ever sabi, and our people dey talk say...

Pan Africanism, Wetin be the meaning sef? Peter obi, truth abi na hype? 23.02.2023

We dey talk say  " wetin old man dey sidon see small pikin wey stand no dey see". The devil get so many tricks for him pocket and e dey always manifest dem tricks in so many different ways, sometimes some of dem ways go seem so true sotay, even an acclaim man of God fit fall for dem tricks. Naija people,  una see this   Nigerian 2023 election wey go happen on Saturday so, e go eithe...

Melanin, The African Diet Story / Stop Lying! Abeg stop telling us bs 18.02.2023

Una sabi say, in this world wey we live, human beings, we come in different forms ,sizes and colours and I be damn if anyone go come on social media to tell the whole planet that a certain food is compatible for the occupants of each and every Continent  on the Planet, all these "doctors" who dey come online this days copying and repeating things the great dr Sebi said many many years ago but...

Wahala get bigger head, abi? 11.02.2023

Have you ever get the feeling like say, u wan slap an idiot? if you could, what would you do? You fit translate our article into any other language wey u wan if you no fit decode Naija pidgin English . Darkydey Radio

Church of wisdom, seriously. 04.02.2023

Honestly, there should be churches of wisdom everywhere, wetin i mean be say, we suppose get churches wey dey preach wisdom and knowledge to the people, not tithe giving and heaven and Yt Jesus, make we build churches wey we go dey go there go dey get wisdom and spiritual education. Darkydey Radio here

What´s with all the Woke BS? / Fat girl, put some cloths on / Obesity is unhealthy. 28.01.2023

See, e get somethings wey dey quick to dey make me vex, wey go make me go from "you know" to just vex. Ma people, nothing cool about obesity as far as am concern, i know say e get some people wey dey struggle with obesity and are seriously trying to lose some weight, but wetin dey vex me be those fat people wey no get shame at all at all. If you be celebraty or you called yourself celebraty, I wan...

Welcome to 2023 14.01.2023

But hold on for a freaky minute, have you taken stock of 2022? wetin you bin don archived in 2022 before you begin dey plan 2023? (Pidgin) How many lives did you positively touched in 2022? How was your stress level in 2022 and wetin you go do in 2023 to level am?  Make we discuss......

Personal Message to fellow Naija People / Nigeria 2023 Election 11.01.2023

The much awaited 2023 wey we bin dey wait for, dön arrive, in about a Month from now Naija people go line up to elect dem people wey dem wan handover the leadership of that great, beautiful Country to. Before you comot go stand for line to vote, make u sabi say na the only chance wey u get to change the condition wey those people wey dey gofment dön put you through. No allow anybody use stolen mon...

Must I Believe In Your Jesus? Hmm! Ma People, I taya-oo 07.01.2023

DARKYDEY RADIO We are  excited to Annonce the commencement of Darkydey Web Radio starting January 1st 2023 on www.darkydey.com hosting on Krachouse Network, You can now listen to live podcast session and old-school / New-school Nigerian and African music, Talk shows with guest and call in sessions. 2022 is coming to an end very soon, we are about to transit into a new year, on the 31st of Dec...

Safety 19.11.2022

Safety

Oga Mustapha, Obi And The Rest, how far na? 12.11.2022

2023 election don dey reach small small, me i still dey ask say, na who fit come deliver our sweet nation Naija from her present predicament? Listen....

Evolution! 05.11.2022

Some ´body bin shark ogogoro finish come talk say we decent from Monkeys and ape, dis one i no need to write too long, just listen for yourself......

Are Black People, Africans? 29.10.2022

This na one of those kind episode wey make you feel say i don dey kolo but make we ask ourselves abeg, where we as darky people really bin comot from come and wetin we do wey make everybodi hate us so damn much? Listen......

The People You Surround Yourself With Are The Cause Of Your Wahala. 22.10.2022

E fit bi say I dey yarn Non sense wey no make sense but i fit guarantee you say some of the things wey dey happen in your life come from the negative spirit surrounding the people you hand around with, listen...

Language, True Or False? Should you be Speaking Another man Dialect? 16.10.2022

Dis one heavy pass me so i go just shut my mouth and allow una listen to wetin I get to yarn..

Black Palm Kernel Oil, Why is no one talking about it? 09.10.2022

Na dis oil here na im i wan yarn about today, e get somethings wey be say we dey ignore, instead make we dey do or dey eat the things wey we sabi say dey good for our body, we dey instead chose to do and eat and apply the wrong and dangerous things on our body, make we talk about this organic oil. Check out the Oil Here

Wetin be Life and why you dey stress? 02.10.2022

I don talk am before say, nothing for this life wey we live be "by force" so why u dey worry about the things wey you no fit change? Why are you killing and stressing yourself over things and situations you cant change? Visit our store

I WON 106MILLION EUROS...........in my DREAMS LOL! 25.09.2022

So people, we dey talk say, Wahala dey sleep, yanka kom wake am up, e get somethings wey be say you just no fit wrap your head around it, e go just make you dey scratch your head and in some instances you go just begin dey laugh because you sabi say in your Universe dat kind thing no fit happen, infact make una just listen to this tori first. Check out our store 

The Case Of SALT / Organic Kernel Oil 24.09.2022

is salt bad for your health? wetin salt dey do inside your body and how does it affect your well being? abi na English we wan yarn now? lol!! Check out the Mmayaha Oil Here Its an organic 100% pure palm kernel oil, makes your skin smooth, gets rid of wriggles, helps with loss of hair, its what am using and it makes my 40something year old skin looks like a 10year old, try it on our site. picture

Ever Seen An African With Food Allergy? 18.09.2022

In all my life on this our beautiful, i have never one came across a darky person wey get food allergy, we dey wag everything, as in everything and i mean literary, but me, anytime I eat something for here I go begin dey cough but as I go reach my Country Naija dey eat dem same things, nothing happened so e come dey make me wonder say, Wetin dey go On?

African Food, Really? 11.09.2022

So wetin or which of dem foods wey we dey refer to as African foods? Why bi say after dem don mindfuck you finish come give you certain unhealthy products, you come begin dey call and lebel dem "AFRICAN FOODS" wetin concern Africans, concern cow body? Abeg Listen below..

Höre den Podcast DARKYDEY IN PIDGIN in Replaio

Radio und Podcasts in einer App - kostenlos und ohne Anmeldung. Installiere sie noch heute und verpasse den Start nicht

Bei Google Play herunterladen

Replaio ist kein Herausgeber von Podcasts; die Namen der Sendungen, Cover und Audioinhalte gehören ihren Autoren und werden über öffentliche RSS-Feeds verbreitet